Put Yur Trust In Oga God
Pipu wait wait on God weh no go dey put to shame onda wateva condition. Dem go also get konfident fo dea future, and dem go get enough kourage to do wetin God want. Di psalmist tok am well-well wen he tok say, “Make you trust God and do wetin dey good, den you go get peace fo di land and you go prosper. Make you depend on God and E go give you evritin wey you wont. Make you kommit evritin wey you dey do fo God hand. Trust am and E go help you. E go show sey you dey innocent kon defend you fo publik. So, make you wait fo God with patient! Make you get mind as you dey wait am! Make you nor worry about wiked pipu wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get. Make you nor dey vex, bikos na trobol, vexnashon dey bring. God go distroy wiked pipu, but na doz wey trust God, go inherit di land.” (Psalm 37:3-9).
LESSON
All belivas must to trust God, and make dem no dey jealous of di ungodly pipu. Pesin wey kip hin trust in God go dey sure of beta future. On di oda hand, pesin wey no trust God go remain food fo Satan. Di enemi may turn dea life to an operation field wea he go dey carri out hin dirty works. So, He dey good make evrione be God friend con trust am so dem no go fit be fool fo devil – so dem go fit prospa well.
PRAYER
God abeg, I know way any pesin wey trust you go dey strong kon dey prospa: now, I go dey trust you. I belive you and I believe your Son Oga Jesus Krist. I dey use dis opportunity to ask fo your grace to det trust you more. I wan to dey serve you faithfully, and I wan make you dey hapi to anytin wey I dey do. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
