Kristens Must To Dey Determined To Follow God
Jesus Krist tell Hin folowas his followers say make dem stay away from dea old and sinful lifestyles. He tell dem say make dey faithfully folow am so dem go fit enta God kindom.
Oga Jesus tok say, “ Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own. “I don dey tell una all dis tins since I dey with una. But di pesin wey go help una na di Holy Spirit, wey my Papa go send kom fo my name. E go tish una evritin and e go help una remember evritin wey I don tell una.” (John 12:24-26).
LESSON
He go take serious determination fo any pesin to be a konfam shaid of God. Kristenity na be a wayo-wayo religion, and no be fo pipu we neva dey ready to folow Oga Jesus Krist. Since Oga Jesus Krist don show thorough Kristenity through Hin own death on di kross (Kon wake up), He no go accept any kristen wey no serious fo heaven!
Any pesin wey tok say dem be born again must dey serious with his/her konfeson. Di pesin must say “bye-bye” to di old lifestyle,and dey ready to live in a new life in Oga Jesus Krist. Kristenity nid make pesin dey serious, and a konfam shaid of God must be willing to pay fo fi price wey dey involved. So, he good make we talk am wella say Kristen must take his/her race seriously since heaven no be for pesin wey no dey serious, but he dey for pipol wey ni go deny dia faith and konfeson of Oga Jesus Krist as dea Lord. Big reword dey fo serious Kristen fo heaven, but heavy punishment dey fo pipu wey deny dea faith fo hell.
PRAYER
God abeg, no I no wan be Kristen wey no dey serious,but Kon make me a Kristen wey dey serious who go dey blessed fo heaven! Kon make my kristen race dey serious, kon make me run di race wit seriousness. Abeg help me ovacome my limitations and temptations so I no go fall your hand on di last day of judgement. Again, con give me di pawa to reject sin wit di pawa of di Holy Spirit to deklare my stand wit you say I be your true shaid. Abeg do dis and many more! Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
