Praise Wey Dey Acceptable
King David get one lifestyle wey be say he like to dey kompos song and dance before God; he love to dey show hin prayers through songs. On di oda hand, wen pipu no think of, Oga God turn David psalm to prophecy. God vex ova di kain attitude wey hin pipu dey show to hin law. Di Spirit of God talk say, ”Na how long pipu go take dey talk bad about me? How long una go dey talk wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie fo my head? Make una know sey, God dey keep dose wey dey fear am fo ensef and E go answer wen we call am. So make you fear God and nor sin. Make you think about am fo night kon turn from your sins. Make you offer sakrifice with di right spirit give God kon trust am.” (Psalm 4:2-5).
LESSON
Oga God loves our praises, but he like say make we dey righteous to him. We most no try to bribe Oga God while we still dey live life wey dey sinful. God no go dey moved wit our mago-mago behaviour, he want our konfam repentans! Now, if we no want say make our praise be waste of time, but we want make God accept dem, we most to dey faithful. God wey dey heaven go celebrate us if we dey loyal to him, he go bless us if we kip our good relationship wit him.
PRAYER
Oga God, I wan to dey give yu quality and praise wey dey acceptable evritym. So, kip me fit for dis tins wey I wan do. Let me dey kip honest relationship wit yu; help me to repent from my sins patapata, and let me dey kip relationship wey dey kanpe wit yu. I ondastand say I fit be yur true shaid thru di help of di Holy Spirit, now bless me wit yur Holy Spirit. Let me dey live for peace and dey enjoy all yur benefits for all di days of my life. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
