Interpret Di Bible By God’s Inspiration
Di Jews no fit get ova di fact say Oga Jesus Krist call hinsef “Di Bread of Life” and dey plan say dem go disgrace am by all means. On di oda hand, Oga Jesus don talk say he go tell di truth about hinsef – even if dem no accept. Di Jews talk say, “Dis Jesus sef nor be Joseph pikin, wey wi know en papa and mama? Na how e kon dey talk sey, ‘I come down from heaven?’ ” Jesus answer, “Make una nor komplain about me give each oda. Nobody go fit come meet me with en own pawa, unless my Papa wey send me draw am come meet mi and I go take am go up fo di last day. ” (John 6:42-44).
LESSON
Bible be spiritual book, and we no suppose use ordinary eyes see am. Any attempt to dey see di skripture with ordinary eyes go turn to anoda thing. We only fit get klear and beta meaning of di bible thru di holy spirit. So, children of God must to dey in spiritual mood whenever dem dey study dea bibles. We must to dey pray fo klear undastanding and spiritual meaning. Also, we must to dey pray say make God give us di grace to dey use di skripture fo our lives. He sure say Oga God go bless us whenever we dey sensitive and understand hin holy word spiritually!
PRAYER
Oga God, abeg help me to spiritually say di meaning of your skripture. No let me dey see bible as one of dose books wey dey inside library, but make i dey see bible as a book wey be from Oga God. Let me dey carry my bible with respect kon dey study am with di beliee say I go receive your blessing. Bless me whenever I study your word, and make my blessing kontinue to inkrease every day. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
