Our Body Is The Temple Of God
The bible lay emphasy ontop di main reasons why kristians suppose no entertain sexual sins. E dey stated
“Flee sexual immorality. Every sin weh a man (and a woman) do outside di body, but hin weh commits sexual immorality sins against hin own body. Or you no know sey your body bi di temple of di Holy Spirit weh dey inside you, whom you get from God, and you nobi your own? Because dem buy you fo one price; therefore glorify God inside your body and inside your spirit, weh bi God(1 Corinthians. 6:18-20).
LESSON:
God require Hin pikin to honor am with purity of body, mind, and soul. In fact, di bible declare am "Our body bi di temple of Holy Spirit" (1 Corinthians 6:19). Hence, e become plain sey God no go appreciate pipu weh entertain sexual sin, but He go judge dem. So therefore e dey important sey every God pikin konsider am as important matter to maintain sanctity of life. Sexual immorality nah abomination to God, and every God pikin must konsider am a plague - and run from am! Jehovah go honor pipu weh honor Am with dea "body and soul," but He go kondemn sinner to di pit of hell - unless dey repent!
PRAYER:
Dear God, I understand sey sexual sin nah abomination to you; therefore, I wan stop di practice fo my life. I dey sorry fo those sexual sins weh i do kommit before, I don dey determined now to live holy life before you. I no go entertain sexual sin again! From today, I go abstain from anything weh fit corrupt my mind; I will stop all my immoral activities. I go be konscious of holiness, and I go do my best to practice am. I beg fill me with your Holy Spirit, and give me pawa to do di right thing everytime. At di end of my earth race, make me dey awarded with your medal of honor in heaven fo sey i stand upright with you. Fo in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
