Dey Follow God Instructions Always
Di tribe of Benjamin rebel against di remaining eleven tribe of Israel, and dey insinuated civil war. Di eleven tribe who remain united ask God fo strategy to use against dea rebel brothers, and He give dem some specific instruction. Meanwhile, di united Israelite loss di battle because dem fail to closely follow dea God-given strategy; however, dem no dey discourage, and dem no stop to dey ask God fo direction. Fo dea third attempt, after don duly follow God order, di united Israelites conquer Benjamin tribe. Dem ouster dea leaders, and dem bring all di tribe to hin knees. Di bible report how Israelites eventually conquer di revolting Benjamin Tribe. He dey reported, “But when di cloud bigin to rise from di city in column of smoke, di Benjamites look behind dem, and smoke dey di whole city going up to heaven. And wen di men of Israel turn back, di men of Benjamin panick, fo dem see sey disaster don come upon dem. Therefore dem turn dea back before di men of Israel fo di direction of di wilderness; but di battle overtake dem, and whoever come out of di cities dem dey destroy in dea midst. Dem surround di Benjamites, chase dem, and easily trample dem down as far as di front of Gibeah toward di east. And eighteen thousand men of Benjamin fall; all these bi men of valor. Den dem turn and run toward di wilderness to di rock of Rimmon; and dem cut five thousand of dem down on di highway. Den dem pursue dem relentlessly up to Gidom, and kill two thousand from dem. So all dos weh fall from Benjamin that day bi twenty-five thousand men who draw di sword; all these bi men of valor” (Judges 20:40-46).
LESSON:
God still lead pipu today; He lead Hin pikin to take appropriate step weh go benefit dea life. However, things fit sometimes no work in way when we no follow God instruction to di letter. Notwithstanding, make we no dey discourage wen we no get expected results; rather, make we summon courage to understand God instruction well, and adherently follow dem. We must not hesitate to consult God over and over again, until we get di solutions weh we dey expect. Our heavenly papa papa definitely respond to our cry. He go answer our prayers, and He go guide us unto victory.
PRAYER:
Dear God, I beg teach me how to dey follow your instructions duly so that i fit get my expected victory over life situation. When you lead, make i follow; and wen i follow, make me prosper. Make me have victory today, tomorrow, and throughout di days of my life. Fo in di name of Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
