Oga God’s Help Present For Hin Shidren
Evil time kom David life; di enemies wey dey close to am surround am, but di man of God know wetin he suppose do. He calll on Oga God fo help, and he no dey disappointed. Di skripture talk some time wey David dey inside problem and how he take calll on Oga God fo Psalm 64 and Psalm 70. Among di many tins wey David ask God, David kry to Oga God say, “My God, make You kwik kom safe mi! Hurry come help me! Make shame and disgrace follow pipu wey won kill mi! Pipu wey dey laf dey sey, “Aha! Aha!” Make You pursue dem go back kon disgrace dem! All di pipu wey dey find You, make dem dey happy with joy, bikos of You! Pipu wey love to see sey You deliver dem, make dem always dey sey, “Make all di praiz bi God own!” (Psalm 70:1-4).
LESSON
Oga God go help hin children, and he no go help dem wen tins no dey go well. Jehovah go defend hin own children until he bring dem fame, kon bring shame to dea enemy. Di Almighty God wey dey kare fo hin children no dey sleep. He dey go straight to action, and he go dey sure say perfect deliverance dey fo pipu wey put dea trust in am.
PRAYER
Oga God, I dey look up to you fo help during my time of need. I call you into my situation, and I beg you say make you help me. Abeg provide solution to all my problem, and let your goodness show fo my life to di fullness. Also, konfuse my enemy, make dem fall at dea evil plan and wetin dem dey think. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
