God Di Saviour
Oga Jesus Krist care fo pipu wey dey hungry; he no preach to dem only, he also feed dem join. At least 5,000 pipu chop from Jesus’ food-for-all miraku program fo one time. Di skripture talk sey, “Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipu wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well.” (John 6:11).
LESSON
Oga Jesus na di Savior of di world, but no be all be dat! Na hin be di giver of physical mirakus! Krist get pawa to help both di physical and spiritual needs of di pipu wey trust am. Any pesin wey trust Oga Jesus Krist no go dey ashame! Pesin wey call Oga Jesus fo help over any mata go see am. Di pesin no go ever dey ashame say he call di Son of God fo hin situation. So, all pipu must dey put dea trust in Oga Jesus Krist wey get pawa to do everything.
PRAYER
Oga Jesus Krist st, I bring all my yawa before you, and I ask say make you solve everything. Abeg, provide fo my physical and spiritual need, kon make all situation turn to blessing fo me. Kon help me dey see your goodness fo all di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
