Oga God No Fit Dey Deceived
Judas Iscariot leave hinsef make di devil use am, and he betray Oga Jesus Krist wit a kiss. He dey repoted say, “As Jesus still dey tok, at wons, some pipol waka kom and na Judas lead dem. E waka go meet Jesus kon kiss am for face. So Jesus ask am, “Judas, na kiss yu take sell Man Pikin?” (Luke 22:47-48).
LESSON
If a klose pesin like Judas Iscariot fit betray Oga Jesus Christ, who we wan trust den? (Luke 22:47-48). He dey klear say dis world wey we dey so get problem wit “Trust”. Di world dey full of hate and anger; acts of na only my own I know don kova evri side! Howeva, di folowas of Oga Jesus Krist still get hope in dis world wey we dey so; we get Oga God love wey win ova evil! We still fit look up to Oga God and some fellow bilivas. On di oda hand, no biliva dey expected to put all hin trust in human being like him. All hin trust most to dey in God who no fit fail am. Oga God no fit fail even wen pipu fail us. Human being like us fit disappoint us, but Oga God no go ever do so!
PRAYER
Oga God, abeg help me to dey kip my trust in yu. Help me to love and trust pipu, but let all my trust dey in yu. Let me trust, pray, and dey look up to yu for my nids. I ondastand and bilive say yu go send me di necessary pipu to mit my nids evri time. Let my absolute trust dey insaid yu evri time, so dat I go fit live successfully and dey joli on eart. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
