Idol Worship Dey Vex Oga God
A King wey he name be Jehu talk say he go take one decision wey radika but dey popular to defend Oga God interest in Israel. He use hin feet against juju woship, and he kommand say make dem kill dose wey dey woship juju. Di skripture tok am say, “Dem bring di pila for di juju temple kom outside kon burn dem. Dem break di juju image and en house and na der pipol dey shit put kon rish today.” (2 Kings 10:26-27)
LESSON
Oga God no like make pesin dey woship juju, and he dey reject dose wey dey woship juju. Oga God na di only idol wet all pipu most to dey woship: No oda idol dey in di air, on di land, or in di sea wey we most to woship! Oga God be Jehovah, and na him make heaven and eart; he no go share hin glori wit any pesin. Any oda pesin or idol wey klaim glori for hinsef most to dey rejected. All honor and glori most to be to oga God only – evri time.
PRAYER
Oga God, abeg help me so I go fit fokus my services to yu only. No let me dey serve idol, and no let me dey share yur glori wit anoda pesin. Let my total heart dey kommited to yu all di days of my life, so dat I go enjoy yur benefits on eart and for heaven. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
