No Allow Doubt
Di blind man wey Oga Jesus heal appreciate Hin healing kon dey praise Oga Jesus, even say di pharisees tell am make he no do so. Wen di pharisees see Oga Jesus as a sina kon say, “Weda na sina e be, I nor know! But wetin I know bi sey, before I blind, but naw, I don dey see.” On di oda hand,di pharisees continue to force di man make hin leave hin healer”So dem ask am again, “Wetin E do? How E take make you dey see sef?” E kon answer dem, “I don tell una before, but una nor gri. Why una won hear am again? Abi, una won be En disciples too? Dem shaut fo di man kon say, “Na you bi En disciple. Wi be Moses disciples. Wi know sey God tok to Moses, but we nor know where dis man from come.”(John 9:26-29).
LESSON
Everyone must to dey claim dea miracle wey God give dem by faith. We must no dey think say God no fit do am and enemies doubt to pressure us to stop to dey announce our miracles. Di bible talk am say, “My righteous pipu go live and believe” (Hebrews 10:38). So, we must understand say no one fit enjoy di benefit of God witout say we show faith.
PRAYER
Oga God, I understand sey faith na impotant part of christianity and no one fit enjoy you without am; now, I ask say make you please bless me with grace to get faith. Make me dey apply faith to whatever i do, and make me dey confident always to celebrate dea benefits inside my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
