Di Greatness Of God Pawa
King David understand God well-well, and hin enjoy hin benefits well-well during hin lifetime. David describe God say, “God laws dey correct and E dey safe life. Di laws wey God give us na truth and dem dey give wisdom to pipu wey ready to learn. God commands dey right and E dey put joy fo pesin heart. En commands dey clear and E dey give pesin hope to stay fo dis world.” (Psalm 19:7-8).
LESSON
Oga God dey great in pawa and hin rule go last forever. Na Jehovah get di whole world, and Hin get di pawa to control all things as Hin like; so, anybody wey choose to be di friend of God go live to enjoy Hin benefits. However, pipu wey disobey God go receive dea punishment fo hell fire.
PRAYER
Oga God, I understand say you go bless your friends fo heaven but punish your enemies fo hell; now, I won be your friend. Abeg guide anything wey I dey think and my action so dat I go always dey fit to receive your benefits. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
