Make your investment bi fo heaven, make he nobi fo dis eart.
Oga Jesus krist tell him pikin wey dey folow am to dey invest wetin dem get fo heaven so dem go fit enjoy life wey no dey end joli from God. oga Jesus krist talk one stori so hin go explain wella wetin hin dey talk, he kon say; “One rish man plok plenty food from en farm, so e kon tink fo en mind sey, ‘Wetin i go do naw? Bikos i nor get anywhere to keep all dis food wey i plok so.’ “Den di man sey, ‘I know wetin i go do: I go skata my stores kon build new big-big one wey i go keep all my food and oda tins wey i plok.Den i go tell mysef, “You get plenty food wey go last you fo many years, so make you go sleep, chop and drink, dey enjoy yorsef!” “But God kon tell di man, ‘You bi fool! Dis nite, you go die, den who go kon get all dis tins wey you don gada fo yorsef?’ “Na so e go bi wit pesin wey dey gada money keep fo ensef, but en heart nor dey with God.”
LESSON
Pesin wey de tink of dis eart only and wey no invest anitin fo heaven no go get anitin on God last day of judgement.
Dis world rishes na fo small tym, dem go just dey fo sometym and go, pesin wey rish today fit kon die poor tomorrow. if he kon later die rish sef and leave am fo hin pipu, dem fit later no use am well. But anitin wey pesin sow fo heaven no dey finish but he go dey lailai, anitin wey dem kip fo heaven go dey kip fo life wey no dey finish. Anitin wey dem call say na heavenly investment must to call pipu attention to God and to bring God glory. If we wan talk about some effort wey fit get heaven: Kristen wey dey kea, pray fo oda pipu go get hin mark to kolet hin reward fo heaven, Kristen wey dey lead oda pipu to oga Jesus krist go get hin mark!. So, all pikin wey bi fo God must to show oga Jesus krist behavior on eart and make sure say them make pipu enter God kindom so dem go receive heavenly benefit wey no get end.
PRAYER
God abeg, kon make mi dey kanpe, make i dey invest everitin i get fo your kindom wea mago-mago no dey, no let dis worldly tin hold mi, no let mi dey porsu am like say dem bi di tin wey i dey find, kon give me pawa to invest all i get fo your kindom, kon let me represent you fo dis eart so i go dey qualify fo your heavenly benefit wey mago-mago no dey. Kon let your holy spirit guide mi in all tins so i go fit prosper. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
