Komplete obedience dey important fo God blessing
Israelites no obey wetin God tel dem wey bi say make dem komot all di Canaanites wey dey di land of Canaan wey he promised dem. Di Israelites leave some pipu fo di land, dey kon join dem also, dey kon dey worship di god wey bi fo di Canaanites (dose wey di Israelites leave kon become dea enemi). Israelites sef kon scatter afta dey don lost dea sense of unity which kon make dem weak. God kon dey angry wit hin pipu and he kon stop to dey protect dem and dey sofa well-well from dea enemis. Di skripto talk say;"Israel pipu sin against God and dem kon start to serve one juju wey dem dey koll Baal. Dem forget di Oga wey bi dea grand-grand papa God wey bring dem kom out from Egypt kon bigin follow and woship di pipu wey dey around dem, gods". (Judges 2:11-12).
LESSON
Shidren of God must to obey God so dem go receive hin benefit. we no fit dey do" mago-mago disobedience "wit God. To talk am well-well sef, fo oga God, notin bi mago-mago obedience, na to obey or make you no obey him. History talk am say pipu fo di bible wey dey do mago-mago obedience fo wetin God talk face di sofa.
Fo example, Israelites no porsu di Canaanites finish as God tel dem, dem kon sofa fo wetin dey do, as king saul sef no kill finish di Amalekites as God talk am, he sofa for wetin he do well-well (1Samuel 15). Di same God wey folow wetin he talk no go leave any of hin pikin wey no obey am patapata. So, we (belivas) must to dey try obey God and do our best make me satisfy am fo wetin he want everitym even wen we no dey fit. Jehovah go reward us if we folow hin rule, but he no go play wit any beliva who wan show say hin wise pass am wit "mago-mago obedience".
PRAYER
God abeg, kon help me to dey obey you so i go fit prosper fo dis land wey i dey live, no let me dey do mago-mago obedience. I know say disobedience do lead to sumtin wey no good and i no wan dey part of it. Kon give mi pawa wey be from di holy spirit so i go dey work fo your ways and i go dey obey you so i go fit prosper, put am fo my heart your fear so i go live a joli life on eart and also make am to your eternal kindom. Na fo oga Jesus krist name i beg all. AMEN
