Mago-mago Behavior Get Repercoson
Di present world na fo di main tym; everitin wey dey di world go korrupt join, and dem go soon perish. A preacher wey wise fo di bible tok say, “ di world contains is temporal also. All di material wealth of this world dey corruptible, and dem go soon perish. A wise preacher in the bible talk am, “As I tink about evritin wey human being dey do fo dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.” (Eccl 1:14).
LESSON
Di present world wey pipu dey live now go dey fo di main tym. All di material wealth wey pipu don see fo eart go korrupt and no go last foreva. Howeva, Oga God go fornish a new heaven and new eart fo Hin saints, wey go dey foreva (Revelation 21:1-4). Di beauty and rishes wey dey di new paradise of Oga God go stay foreva. But, Oga God no go allow sinas make dem enta Hin beautiful kindom. He go send dem go hell fire wey go be di pamanent home fo Satan and all Hin folowas (Matthew 25:41).
(Anybodi wey accepts Oga Jesus Krist as hin personal Lord, kon repents from hin sin do dey konsidered as a saint of God – and di pesin go enta heaven).
PRAYER
Oga God, I don know say notin dey dis world wey we dey now. Dem go perish and dem go disappear someday; derefore, I don decide to kip my treasures where dem no go korrupt. I don tok say I go give my life to Oga Jesus Krist! Today, I (tok your name) tok my faith deklarasons laidis: I bilive say Oga Jesus Krist na di Son of God; He don die fo my sins so dat I go fit get life wey no dey finish. I konfes my sins of (mention di sins wey you fit rememba). I also konfes evri sins wey I no know. I repent from all my sins and I give my komplete life to Oga Jesus Krist. As from today, I go dey faithfully folow Oga Jesus Krist and I go serve Am fo di rest of my life. Also, since I don bekom di shaid of God, I go share my salvason experiens wit oda pipu. May oga God help me so. Amen!
