Love Dey Impotant
Love dey impotant, and everione must to respond to am. Di value wey be fo love no fit dey changed fo any oda virtue. Di skripture tok am say, “Even strong wota nor fit kwensh love; river nor go fit swallow love. Pesin nor go fit buy love with all en propaty, bikos dem nor dey sell am.” (Song 8:7).
LESSON
Love dey ogbonge and impotant fo all pipu. God ask say make evrione get konfam love fo oda pipu. But, some pipu dey abuse love and dey konklude say anitin we dem dey kol love must to bring personal gain. However, love no dey selfish. Also, love no dey equal to sexuality. Love dey selfless, karing, impartial, and godly. So, everione must to dey see wateva dem get as love. If di result of wetin dem get no dey satisfy wetin God want fo righteousness, no be love!
PRAYER
Oga God, abeg flourish my heart wit konfam love wey go benefit oda pipu and me. Also, let di demonstrason of my love turn to di glorifikason of your name. Make my love dey selfless, impartial, trutful, and fruitful! Na fo oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
