Kristen And Kulture
Di Pharisees don dey blind wit traditions and dem no fit talk wetin di skripture say well-well. Many pharisees don miss salvation opportunity, bekos say dem believe say Oga Jesus come from a small town! Even after di signs and wonders wey Krist perform, di pharisees talk say Galilee dey small to produce dea messiah. He dey written say, “… Wen pipu hear wetin e talk, some of dem kon say, “True-true, dis man na Him be di Prophet!” Some still say, “Na-im be di Krist”, but odas sey, “Na lie, Krist nor fit come from Galilee. Abi God word nor say, ‘Krist go come from David family wey dey Betlehem, di village wey David from come?’ ” So di pipu kon divide bikos of Jesus.” (John 7:40-43).
LESSON
All pipu must to dey kareful not to allow religion belief (doctrine) to stop dem from going to heaven. Also, we kristen must to dey run away from traditions wey go affect our faith. Christianity dey different from tradition and rituals; na God hinsef plan di movement. So, we must to dey rely on di Holy Spirit to guide our activities. No christian go reach di presence of God without sey di Holy Spirit guide am. Di skripture talk am say, “But di time dey come and e don even reach, wen di pipu wey won really serve God, go serve am fo di true way, wey God Spirit go show dem. God na Spirit and di pipu wey won serve am, must serve am fo di true way wey God Spirit go show dem.” (John 4:23-24).
PRAYER
Oga God, abeg give me grace to be christian wey no dey cage inside human traditions. Come help me so I go fit give holy spirit di chance to lead and operate in a way wey go glorify your name. Come give me pawa to dey serve you with all my heart without say I dey find make human praise me. Let my service dey ogbonge before you, so that I go receive my reword on eart and fo heaven. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
