God Prepared Hell For The Wicked
God hates wikedness, and he no go spare wiked pipu from ponishments. Di skripture tok am say God go sofa di wiked pipu for hell fire. He dey written say, “God dey see both good and bad pipu. E hate dose wey love to dey find trouble. E go burn wicked pipu with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze. God dey good and E dey judge well; so E go favor dose wey dey do good too.” (Psalm 11:5-7).
LESSON
Wetin Oga God think wey be say to punish di world fo dea wickedness dey inside di bible. Both di Old and New Testament of di bible don talk am say God go stop di world wey we dey so wey dey full of wickedness and he go cast am to hell fire - join with di sinas wey no repent. But, before di eart planet go dey destroyed, Oga God go gather kon carry hin saints to di new eart and new heaven wey he don prepare fo dem (Revelation 21:1-5). Oga Jesus Krist offer di only escaped way from hell fire. Anybodi wey accept Oga Jesus Krist as hin personal Lord and Savior go escape hell on God last day of Judgement. Some bible verse wey talk di need of repentance and konfeson of Oga Jesus as Lord dey down laidis:
-
Psalm 11:5-7: (God dey see both good and bad pipu. E hate dose wey love trouble. E go burn wicked pipu with shako, sulfur and fire kon destroy dem with strong breeze. God dey good and E dey judge well; so E go favor dose wey dey do good too).
-
Psalm 49:13–14: (“Dis na wetin go happen to fools and pipu wey believe wetin dem dey teach. Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dea grave; di place where Deat go bi dea shepherd and oga. Fo morning, pipu wey dey fear God go rule over dem. Dea body go rotin fo grave wey nor even dey near dea fine house”).
-
Matthew 25:41: (“Di king go tell di pipu wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare fo devil and en wicked angels”).
-
Matthew 10:28: (“Make una nor fear who go fit kill di body and nor fit kill di soul. Instead, make una fear God wey fit distroy pesin soul and body fo hell-fire”).
-
John 14:6 (“Jesus answer am, “Na mi bi di road, di truth and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass through Me”).
PRAYER
Dear Lord, he don do, I no won go to hell fire but I want to go heaven! Now i dey fully determined to stop playing with fire. As from today, I offer you (Jesus) my spirit, soul, and body. I give you my whole heart, and I declare you as Lord! I confess say Jesus Krist be di Son of God; he die and he resurrect, and Hin be my personal Lord and Savior. I confess my sins and I repent from dem. From now on, I be child of God. I renounce sin and all di work of devil. I revoke my covenant with di devil, and I established new covenant with Jesus Krist. I now declare am loud and clear say I (Mention Your Name) am be born again Christian, and heaven be my home. Amen!
