God dey Una side
Dem Israelite no plenty at-all and dea weapon no fit fight dea enemies, so God kon put mouth fo dea matter naso dey win.
Israelite enemies kon plenty fo dea side like bee God kon fall hin weapon from heaven to defend dem. Di bible talk am " As dem dey run from Israel pipu go di low groun fo Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky fo dea head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill." Joshua 10:11.
LESSON
God fey do anytin fo hin pikin wey won enter wahala, Oga God wey be say hin get all power fo hin hand go do anytin fo hin pikin like to dey jolli. We belivas get jehovah di oga God wey create di heaven and eart fo our side and hin go help us when we nid anytin. Baba God get all weapon fo war, he get some weapon wey den never use and some Kain method to win di enemies. Wetin all belivas nid na to trust baba God even when tins no dey go well, baba God no dey fail but he go make sure say hin use all hin power praise him name.
PRAYER
Baba God, I no say you bi oga God wey create heaven and eart and you get all power to cover your pikin, now i dey beg fo your help as tins no dey abeg kon deliver mi from all enemies wey dey porshu my soul, Safe me from dem bad-belle and fight dem fo me. Help me to dey win everi time so that i go dey serve you well -well , make your songs of testimony never komot fo my mouth, Fo in Di name of oga Jesus krist i beg fo dis. Amen
