Di fight wey we dey fight no bi physical
Oga Jesus krist dey tel hin pikin wey dey follow am about di problem wey dey fo dea front, and hin dey warn dem to dey kanpe. But all di pikin wey dey follow oga Jesus krist no undastand am wella. Di one wey dem surpos dey fast and pray to oga God fo power to konker dea problem wey dey come dea way di pikin wey dey follow oga Jesus krist dey fight each oda and oga Jesus dey warn dem before.
“Make una nor forget wetin i won tell una, dem go sell God Pikin give human being. But dem nor undastand dis word, bikos God hide am from dem make dem for nor know wetin di word mean. Di disciples demsef dey fear to ask Jesus about di matter." (Luke 9:44-45). Di one wey den surpos dey pray kia-kia wey bible talk " Di disciples kon dey ask demsef, Who big pass among us fo God Kingdom? Wen Jesus know wetin dem dey talk, e bring one small pikin near am kon tell dem, Anybody wey welkom dis small pikin bikos of mi, e don welkom mi and anybody wey welkom mi don welkom God wey send mi, bikos di pesin wey small pass among una, na-im big pass fo God Kingdom.” (Luke 9: 46-48)
LESSON
Kristen surpos dey-dey in spirit so tay den go dey konker dea test of faith. Make we dey do jeje so tay di world mata no go let make we lose di betta salvation wey we get from Oga Jesus krist. Belivas surpos dey pray and dey wise wit all Mata wey holy spirit dey lead us make we konker di test wey go stand gidigba Infront of our faith. Make we always no di skriptua wey dey make us dey kanpe fo any test of faith as spiritual fight and make we no dey see am as koro-koro fight as dem don write am."Bikos, wi nor dey fight against human being, but na against di wiked rulers wey dey fo dis world,against evil spirits and power wey dey di heavens" (Ephesians 6:12)
PRAYER
Oga Jesus krist, Abeg help me to dey always get sense fo spirit and dey work under holy spirit. Make i get sense spiritually so tay i go fey fast and pray wen i dey find faith wey i go use konker all di wahala of life.
Make you take me and guide me so tay i go fey win in dis life, so i go fey enter your kingdom. Kon help me make i dey grow in your grace so i go fey dey do wetin you want everitime. Na fo oga Jesus krist name I beg fo all dis.
