You Need Holy Spirit Before U Fit Live Good Christian Life
Some farisees take Oga Jesus krist fo fake profet because hin allow a woman wey dem talk say sinner make she rub am wit oil The farisees believe say Oga Jesus no obey di rule wey go make be confirm prophet because say hin allow person wey no dey holy come to am.
The scripture talk say, "One Farisee kon invite Jesus kom chop for en house, so Jesus enter di Farisee house kon sidan. Den, wen one woman from dat town wey bi sina hear sey Jesus dey chop for di Farisee house, e kon bring one fine oil bottol, wey dey send well-well, kom,E knee down fo Jesus front dey kry and e kon dey wet Jesus leg with di tears from en eye. E klean Jesus leg with en hair kon kiss dem, den e pour di oil put. Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon talk fo en mind sey, “If dis man na prophet true-true, e fo know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi. Jesus kon tell di Farisee, “Simon, e get wetin i won tell you.”
Simon kon sey, “Tisha, I dey listin. E get one man wey get two savant wey dey owe am money, one dey hold am 5,000 and di oda one, five hundred. 42 Wen two of dem nor fit pay di money back, e kon sey make dem forget about di money. Afta dat, wish of dem go like di man pass? Simon ansa, “Na di one wey en money big pass.”
Jesus kon tell am, “Wetin you talk, korrect.” Den Jesus look di woman kon ask Simon, “You dey si dis woman? I enter your house, you nor give mi wota wosh leg, but di woman don wosh my leg with en tears kon take en hair klean am,wen i enter your house, yu nor kiss or greet mi as awa tradishon bi, but since i enter, dis woman neva stop to kiss my leg,you nor pour oil for my head, but dis woman don anoint my leg wit oil wey dey send well-well,make i tell you, I don forgive dis woman en many sins, so en love don big well-well, but di pesin wey dem forgive small sin, en love go small.” (Luke 7:36-47).
LESSON
Kristian nid spiritual exercise and spiritual understanding make he no dey tink say na sumtin wey fit talk wit human knowledge. He go take pesin we dey kampe for spirit to do beta judgment fo any time. No believer fit okay God without say the Holy spirit lead hin life, He get how we fit know true kristianity and na him don dey down here:
1. A beta kristian go always pray say make di holy spirit dey fill am always.
2. A beta kristian go dey always ask say make di holy spirit dey always guide am.
3. A beta kristian go always pray say make di holy spirit dey fill am every time.
PRAYER
Oga God, abeg baptise me wit di holy spirit, make him(holy spirit) dey guide and tell me wetin i go do so i go dey do all tins di way u want am . No let me work for flesh, no let me follow my body leading, make anitin i go talk/do dey bi from di holy spirit. Abeg give me di grace and strength wey go make me fit follow you so i go fit dey jolly every day of my life. Na for Oga Jesus name i beg all this. AMEN
