You Need A Humble Spirit To Dey Do Di Will Of God
Di Pharisees won kause problem between John Baptist and Jesus Krist, and dey come meet John with question wey hard . Di Pharisee talk say, “Oga God, di pesin wey dey with you fo di other side fo Jordan River, wey you talk about before, en too, dey baptize pipu and everybody dey rush go meet am.” (John 3:26). On di other hand, John wey be savant of God tell di pharisees say dem no fit compare him wit Oga Jesus – because say Oga Jesus big pass am. John talk am about Oga Jesus say, “Nobody go fit get anything unless God wey dey heaven, give am. Una sef go fit bear witness sey, I talk say I nor bi di Krist,but God send mi come, before Krist go come.” (John 3:27-28). John also tell di Pharisees, “Pipu must know Krist pass as dem know me. “Di pesin wey come from heaven betta pass everybody wey dey fo dis world. And who dey dis world, dey talk about di things wey dey inside di world. (John 3:30-31).
LESSON
Humility beta pass pride. Humility go bring honor but pride go bring shame. All children of God must to dey humble. We must to dey show humble heart like Oga Jesus Krist wey get all pawa fo Hin hand but still remain humble till He die, so that He go safe di sinas wey don lost.
PRAYER
Oga God, abeg give me grace to remain humble to you everytime. No let me dey proud , and no let me dey think say I get pawa pass others. No let me dey collect your glory fo mysef, and no let me dey give di honor we you suppose get to other pipu. Come fill me with your Holy Spirit to dey do everything wey you want everything. Also, let your Holy Spirit dey assist me to treat other pipu with respect, so that dem go dey challenged to dey praise your holy name. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
