You Must Strive To Grow
The bible challenge all kristians to fully komply with God laws. Believers must live konsistent lifestyles with di bible, and we must dey mature in our approach to physical and spiritual matters. E dey emphasize inside bible,
“Fo though by this time you ought to be teachers, you need one pesin to teach you again di first principles weh bi fo God oracles; and you don come to need milk and nobi solid food. Fo everyone weh partakes fo only milk dey unskill in fo word of righteousness, fo hin bi baby. But solid food belongs to those weh don full age, that is, those weh by reason of use do dea sense exercised to discern both good and evil” (Hebrews 5:12-14).
LESSON:
God get interest to dey see Hin pikin (kristians) growing in closer relationship with Am. Kristian suppose grow in faith, and no remain in same position. We dey expected to grow and improve in our prayer life. We must to dey study bible more, and dey practicalize our faith. As Krist' followers, we expect us to dey strong in faith and become more mature. We must dey talk with God and live konsistent life with Am. If we remain konsistent, our heavenly Father go reward us with Hin benefits fo this life, and in heaven also.
PRAYER:
Dear God, I understand sey you want make my relationship with you improve well well, and i dey ready now. I don make up my mind to serve you better. I dey will to study your word more and live devoted life before you. I beg baptize me with your Holy Spirit to get enough strength to meet your expectations. I beg make my service be acceptable before you, and make me qualify fo your blessing fo this life, and fo heaven also. Fo in Oga Jesus Krist i make my requests. Amen.
