You Must Allow Di Holy Spirit’s Governance In You
Christians most to dey honest wit dia relationship wit Oga God, and dey most to be of good models for oda pipol. Di skripture talk am say,
“Finally, my brodas and sistas, tins wey bi true; wey get respet; wey fine; wey pipol dey tok good about; wey good well-well; wey rish to praiz, na dis kind tins una suppose to dey tink about” (Philippians 4:8).
LESSON:
Oga God want make all hin shidren kip konsistent relationship wit him. Dey most live lifestyle wey go be example for oda pipol to watch. Howeva, no one fit mit such impotant expectasons witout di help of di Holy Spirit. So, he dey impotant make all Christians dey ask God daily for in-filling of di Holy Spirit so dat dey can satisfy his desire well-well.
PRAYER:
Oga God, abeg I nid di di help of your Holy Spirit to be a good Christian. I don know say I dey weak and I no fit mit wetin you want wit my human pawa; so, I ask you say make you please give me pawa wit your divine Holy Spirit! Kon anoint me wit grace to serve you well-well kon be a good example for oda pipol to folow. At di end of evritin, let me receive your crown of glory wey no dey perish for heaven. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
