You dey unbeatable
Mrs Deborah Lapidoth bi prophetess and she bi di Israelites judge wey do wetin oda women no do fo di bible, she talk Barak say make hin prepare a nationwide war against di neighbor country wey dey wahala dem and she folow dem go di battle front.
Fo dat period, di pipu no fit face dea enemis becos say dem no plenti. Barak wey bi di army leader sef talk am and he tell Deborah say make dem no try anitin against di enemi except say Deborah folow dem. To make di Israelites win di war, Deborah do wetin she no sopos do kon folow Barak to war. The scripture talk say "But Barak ansa, “If you nor follow mi go, I nor go-go anywhere.”(Judges 4:8) so Deborah go to di war wit Gideon to defend dea nation and dey kon win di battle (Judges 4:23-24).
LESSON
Belivas must ondastand di post dem dey in God "unbeatable shidren of God".we kristen must have di spirit of God in us and most know say we dey unbeatable. we must ondastand say God dey wit us everitym and he go always dey wit us fo evritin wey we dey do. make we no dey see God presence as small tin fo our lives. we most dey show hin strength wen we dey fo difficult situations, we most to dey defend his standard of righteousness wen no bodi defend am becos our effot go make satan d enemi carry up hin head but anitin wey hin do go turn to opportunity to glorify God's name. That is, God go appear anytym we dey face challenges so he go prove hinsef as strong. Howeva, wetin we fit talk again, shey make we say God go fail pipu wey stand fo hin righteousness, no bi so, Jehovah go surely defend hin name fo evri situation to honor hin shidren and glorify hinsef. so, belivas must to trust God gidigba and kip konfessin his promise in evri situation of life.
PRAYER
God abeg, kon give mi di courage to dey talk your standard of righteousness evritym, kon give mi pawa through di holy spirit so i go stay focus and dey make your righteousness spread by sharing your gospel. Kon give mi di faith wey stubborn so i no go dey cage unda dis worldly act sinful pressure. Also, no let my faith shake to accept defeat during challenges but let me kip konfesin your righteousness until i testify your goodness. Na for oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
