Wrong Approach To Sexual Pleasure
King Solomon who once loved God and ruled hin pipu wit wisdom kon dey full of women and dey cause make he leave God path. Since he don start to dey folow him sexual desire, Solomon no con dey wit God again, and he do some big mistakes. Di bible tok say,“ Solomon kon love many women's wey kom from oda kountry. Apart from Fero pikin wey bi en wife, e still marry plenty women from Hit, Moab, Ammon, Edom and Sidon kountries. E marry dem, even doh God don kommand Israel pipol make dem nor marry from doz kountries, bikos dem go make Israel pipu woship oda gods. Solomon marry 700 wife kon get 300 girl-friends and na dem make am turn en heart from God. Wen Solomon don old, e kon stop to follow God, unlike David en papa wey follow God until e die.” (1 Kings 11:1-4).
LESSON
Unlawful sexual relationship go make any man or woman fall. Immoral relationships dey put pipol for prison. A man or woman wey dey do immoral relationship no dey free, but he/she dey spiritually bind to live as a slave. In fact, no one wey dey inside illicit sexual relationship wey go go free. Di pesin go do sumtin wey hin dere! Therefore, anyone wey wan live a victorious life must to comot body fo any relationship wey fit lead to fornication or adultery. Pesin wey kip hin holy life go receive direct blessin from God – even if di pesin no pray. To tok am well, pesin (single or married) wey kip hinsef pure kon maintain good relationship wit God go enjoy plenti benefits from God on eart and fo heaven.
PRAYER
Dear God, I don know say illicit relationships dey ungodly and fit make anibodi fall from grace, so I ask say make you please help me to dey holy as a single (or married) pesin. Help me to dey stay away from any tok wey fit damage my relationship wit you. Abeg, let me make I dey holy and serve you faithfully so I go fit enjoy your benefits, and so dat I go prospa in evritin wey I dey do fo my life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all. Amen.
