Wikedness Go Lead To Kondemnason
Bible tell di Kristen say dem go soon eskape di present wahala wey dey world now kon go heaven to dey enjoy Hin life wey no dey finish benefits. Di bible tell di bilivas say, “God go judge many pipu kon setol di kworel wey strong nashons get. Den dem go dey use dea swod and spears take dey work fo farm. Pipu from difren kountry nor go fight each oda again or train dea pipu to go fight war. Evribodi go stay fo peace and dem go prospa. Dem go enjoy dea own grape and fig tree, bikos e nor get anytin wey go make dem fear. God wey dey mighty don promise!” (Micah 4:3-4).
LESSON
Kristen fit dey go thru some shallenges fo dis eart, but no go dey foreva. Sofa go finish fo di pipu wey don konfes Oga Jesus Krist as dea personal Lord and Savior. Once bilivas reach heaven, we go get perfect peace wey no get sorrow insaid! Oga God shidren go drink from di river wey dey peaceful wey dey flow from di heart of God. Kristen must to dey hold on to dea konfeson of faith in Oga Jesus Krist since di price dem go receive dey plenti! We must to remain konsistent wit Oga God in dey endure our sofa wey no go be foreva, since dem go soon end. Oga God go klean our tears komot fo our face kon bless us well-well.
PRAYER
Oga God, I love you pass silver and gold. I love you pass my sofa. My goal na to make heaven at di end of my journey fo dis eart; so I pray say make you give me grace to dey kanpe wit you. Help me to kip my testimoni as a shaid of God. No let me deny my stand and no let me stop to dey serve you. Help me dey faithfully serve you to di end so dat I go fit enta your rest to enjoy peace wey go dey foreva. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
