We Must To Dey Folow Oga Jesus
Oga Jesus Krist na di only way wey lead to heaven. No oda way lead to Oga God dan Oga Jesus Krist! Di Savior talk say, “Na true word I dey tell una, pesin wey nor pass door enter di place where dem dey keep sheep, but climb pass anoda side enter di place, na big tif. Di pesin wey pass di door enter, na-in bi di shepherd wey dey guide di sheep. Di gateman go open di door fo am and en sheep go hear en voice wen e call dea name and e go lead dem come out. Wen e don bring all en sheep come out, e go-go dea front and di sheep go follow am, bikos dem know en voice… Na me be di good shepherd. Di good shepherd ready to die fo di sheep.” (John 10:1-4, 11).
LESSON
Plenty religions dey out dere, and some pipu (dead or alive) don claim say dem be Oga God savant wey He send to safe di world. Howeva, no pesin prove this statement as di savior – except Oga Jesus Krist. Oga Jesus talk say he be di only way wey lead to God and he prove wetin he talk. He die kon wake up on di third day and He don talk say He go wake all pipu wey believe am on di last day From now, we don dey convinced to dey follow pesin we don taste death kon wake up at di same time. If we follow Oga Jesus Krist, we go also wake up after we die. So, anybody wey confess Oga Jesus as di Lord kon accept Him as dea personal Savior go dey safe.
PRAYER
I give my complete life to Oga Jesus Krist today, and I accept say He be my personal Lord and Savior! Since Oga Jesus na di only way wey lead to heaven, I go dey strong with am. No more sin and no more relationship with di devil. From now, my life belongs to Oga God and I go serve Him forever! Amen.
