We don get oda to get victory with di power of oga Jesus
All mirakles wey oga Jesus krist do, as dey down fo d skripture bin sumtin wey dey powerful. He wake dead pesin, he heal pesin wey no dey sick, he feed plenty pipu wit shipini bread and shipini fishes Oga Jesus krist dey do some mirakles wey dey shock him pikin wey dey follow am fo mind. Oga Jesus talk to di wind and dem two obey am. Bible talk of di tin wey happen den:
One day, Jesus and en disciples enter kenu, den e tell dem, “Make wi kross go di oda side fo di river.” So dem kon go. As dea kenu dey move for di wota, Jesus dey sleep, den strong breeze start to blow and dem kon dey fear, bikos wota dey enter di kenu,dem kon tell Jesus, “Oga God! Oga God! Na die wi dey so!” Jesus get up kon kommand di breeze make e stop and di wota wey rof before, stop and every where kon kwayet, den Jesus ask dem, “Where una faith dey?” But dem dey fear and sutprise dey tell each oda, “Wish kind man bi dis sef? Even breeze and wota dey obey am!".(Luke 8:22-25).
LESSON
Oga Jesus krist get ogbonge power wey him fit use to put human and spirit to anoda tin. He get some kain power wey nobody fit face, no bi say na only human dey bow for him power, devil sef dey bow for am. Tori, di skripture talk say "Yu bilieve sey na only one good God dey. Demons bilieve so too and fear dey katch dem well-well.” (James 2:19). Di power wey dey di name of Oga Jesus krist dey always trouble Satan if dem use di name.
No bi only oga Jesus krist get dat strong power, him pikin wey dey waka wit am get di same power as their oga Jesus krist. To say, any pesin wey believe in Oga Jesus krist go fit use hin name live life as him do on eart. Tori say? Before oga Jesus krist go back to heaven, he talk am his power with him pikin wey dey follow am,he con talk say" I tell una true word, anytin wey una take prayer tie fo eart, God go tie am fo heaven and anytin wey una take prayer luz fo eart, God go luz am fo heaven.(Matthew 18:18). Now wey oga Jesus krist don prepare victory fo hin pikin wey dey follow am so dem go live like am, make kristians dey try use dat chance. Believers no suppose dey live in fear, shame or regret, we bin raise our head so we go enjoy oga Jesus krist authority and dey win every time.
PRAYER
Oga Jesus Christ, i believe well well say we bin share di same mirakle power and i don ready to use your name to win. Wit strong believe, i dey talk all dis. I dey kommand satan make hin leave every tin wey bi fo me. I kommand all di enemies chain make hin break komot fo my life in di name of oga Jesus krist, every tin must work fo well from now. My time don come to dey shout di shout of victory and dey sing hosanna song to di name of my God, i tank you say you don give am to me victory wit di power wey dey your name. AMEN
