Trust God
God dey kare fo Hin shidren and He dey protect dem from dea enemis. On di oda hand, an enemi wey harass God don turn to God’s enemi, and he dey play wit fire! David know wetin dey down wen he tok am fo hin psalm, “Make God raiz-up! Make all En enemies skata! Make all di pipu wey hate am, run as dem si am. As breeze dey blow smoke, na so too You go drive dem go and as butter dey melt near fire, na so too wiked pipu go die before God. But pipu wey dey fear God go dey happy; Dem dey happy fo God go dey happy; Dem dey happy fo God present and dea joy nor dey end.” (Psalm 68:1-3).
LESSON
God get enemis, and hin enemis be pipu and forces wey dey harass kristens. Di kreator no go take am well wit di enemis, but He fit do anitin to defend Hin interest in di lives of Hin shidren. Wen God dey fight a battle, pipu go dey shock, and di outcome go outburst evribodi mind! So, shidren of God must to kip dea trust in God; make dem call him to defend dem in tym of trouble.
PRAYER
I shalenge Satan make he stop messing wit me bekos I dey carry di fire of God! I ovacome all enemis influence fo my life in di name of Oga Jesus Krist! Since I be shaid of God, my battle na God battle and my enemis be God enemis. So, I kol on di pawa of God ova any harassing situasen in my life, and I kommand dem make dem melt lile wax melts before fire. I deklare wars ova my enemis, and I scata dem wit force. I destroy dea plots and I renda dem powerless. Fo I don make dis deklarasons by di authority in di name of Oga Jesus Krist. Amen.
