The Best Is Reserved For You
God promise new and better kovenant with Hin pikin, as they reserve dea trust in Am. The bible say,
“...Because if di first kovenant no get fault, then no change no go dey fo di second. Because finding fault with dem, He says: “Behold, di days dey come, the Lord talk am, wen i go make new kovenant with house of Israel and with Judah house— nobi like di kovenant weh i make with dea papa in di day wen I take dem by hand to lead dem out of Egypt land; because dem no kontinue in My kovenant, and I disregard dem, the Lord talk am. Fo this nah di kovenant weh i make with di house of Israel after those days, the Lord talk am: I go put My laws in dea mind and write dem on dea hearts; and I go be dea God, and dem go be My people. None of dem go teach hin neighbor, and none of dem go teach hin
brother, say, ‘Know di Lord,’ fo all go know me, from di least of dem to di greatest of dem. Fo I go be merciful to dea unrighteousness, and dea sins and dea lawless deeds I go remember no more” (Hebrews 8:7-12).
LESSON:
God don make inhabitants of this earth witness Hin signs and wonders in so many ways. We don see amazing wonder works of God - Di beautiful kreations and nature. Meanwhile, none of di kreative works of God ever witnesse fit be kompared with those weh still keep in reserve. Some superb and most amazing works of God go be displayed fo heaven (and in di earth weh dey come) fo kristians to enjoy. Believers in Jesus Krist - kristians - go receive free pass to enjoy God hilarious display of Hin kreative works in heaven! In fact, Di saints no go only witness dea demonstrations, but dem go also benefit in dea actuality! Kristians go live to enjoy God goodness fo heaven perpetually. For dis reason, kristians suppose kongratulate themselves fo God don reserve Hin best fo dem. Meanwhile, pesin weh nobi kristian suppose endeavor to become kristian so that him or her fit be qualify to enjoy di tremendous works of di kreator in heaven, and on earth.
PRAYER:
Dear God, I want to go to heaven, I beg kount me worthy! I beg qualify me fo your kingdom so that i fit enjoy benefits pass i ever get! I beg make me to be good kristian weh go follows you to di end. I dey re-dedicating my life to your Son Jesus Krist, and i give my komplete life to Am. I honor Am and i accept Am as my Lord and personal Savior. I beg write my name in the book of life. Kount me worthy fo your eternal home. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
