The Believer’s Konfam Love To God
God desires unconditional love from Hin children. He wants us to dey serve am without any hidden plan. He go bless us if we serve am well, but our service must not be bekos of di favor wey we won get. Christians motive of service must dey similar to wetin Prophet Habakkuk talk in di bible, “ Even as di fig and olive tree nor get fruit naw and di grape nor gri grow fo di vine or sey di land produce corn and all di animals don die, I go still dey happy and sing fo joy, bikos na Oga God dey guide mi. God wey get pawa dey give mi strength. E make mi stand strong fo ground deer kon keep mi safe on-top di mountin. (Fo di choirmaster: Make dem sing dis song with instrument like, jita.” (Habakkuk 3:17-19).
LESSON
Christians no dey different from oda pipu; we get our own past (sweet or sour) experience. On di oda hand, Krist find us, clean us, kon safe us. Even say we fit still dey lack one tin or di oda, but our motive behind serving God must dey without condition. Some things fit don bring us close to God, but dose tins don become secondary. Our primary motive na to serve God without condition! Christian must dey serve God whether rain dey fall or sun dey shine . We must to beautifully serve God – whether everything wey surround us dey good or bad. Children of God no fit allow dea problem kova dem and disturb dea relationship with God. A child of God must remain committed to God – whether he/she see wetin he dey expect! However, our heavenly father dey able and strong to cater fo us. He go meet our needs and satisfy us if we fit show say di love we get fo am na konfam.
PRAYER
Oga God, he don do di game wey i play with you! I don talk say i go dey serious in my relationship with you. I no go serve you fo wetin I won get only, but I go serve you without say I won collect anything. I go give you my time and energy to dey sing beautiful songs and pray confirm prayer to your holy name. I go serve you: share your gospel and support dose wey dey share am. I go allow your Holy Spirit to dey teach me and lead me into di truth of di bible. Again, I declare say I don sell all my heart fo you Oga Jesus! My loyalty and love wey no get condition go remain fo you, and only you! My declaration remain konfam today, tomorrow and forever! Na fo Oga Jesus Krist I make all dis declarations. Amen.
