Sure Viktory For Di Faithful Christian
He dey good to be a good man and a good woman. Di skripture talk am,
“Pipol wey dey dash oda pipol money, Dey do dia business well and na dem good tins dey follow. Evil nor go fit kill doz kind pipol. Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem. Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem. Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies.nDem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.” (Psalm 112:5-9).
Lesson:
A good pesin wey faithfully folow God no go dey ovakom by any storm in life. Di batu fit dey tough but Oga God go bring hin folowas wey dey faithful to a safe place. Even wen dem dey sofa pipol, sons and daughta of God go shout for viktory; but, di wiked pipol wey dey sofa di righteous ones go melt like wax dey melt before fire, and dey go blame diasef - onless say dem repent.
Prayer:
I pray say make Oga God establish my heart to dey kanpe and not be moved by any windstorm of persekuson or attack. May di Lord Oga Jesus Krist kip me safe till di day of his second comin wen he go carry all saints to hin home for heaven. May he count me worthy to receive hin crown of glory wey no dey perish, kon dekorate my life wit beauty and honor foreva; Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
