Stay Clear Of Self – Praise; Give Oga God All Praise
Christians must to dey avoid self-praise, but we most to dey show our glorification in God. Since Krist na evritin wey we get, we most dey sure say we glorify him in all situasens and evritime. Di skripture talk am say,
“Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do” (Philippians 3:3).
LESSON:
We Christians have no get any oda pride except from Oga Jesus Krist; so we must to dey rejoice in him evritime. We most to dey run f from self-glorification but dey give all honor to di Lord! Di savior don bless us wit hin plenti grace of salvation, and he don also promise us crown of glory wey no dey perish for heaven. From now on, bilivas most dance before him kon deyb celebrate hin goodness from now and foreva.
PRAYER:
Oga Jesus Krist, wat an awesome Lord you be! You sacrificed your life to save my soul! I go praise you from now on. I go sing, dance, and talk your goodness to all di eart. I don determined to stop dey praise myself, but give you di honor wey you sopos get all di days of my life. So help me Oga God! Amen.
