Stand Kanpe Wit Oga Jesus
Apostle Paul tell di saints in Philippi kon say,
“Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand. Make una nor fear una enemies, bikos dem go soon skata and dat na sign to show sey God go save una.” (Philippians 1:27-28).
LESSON:
Na impotant effort to stand kanpe wit Oga Jesus Krist. Sofa of saints would rise, but bilivas most endure dem all. Oga God kip hin big rewods for folowas of Oga Jesus Krist wey refuse to bow down for oppositions. He go rewod our steadfastness wit his crown of glory for heaven. No be only dat, Oga God go also make our work on eart to stay. Our good works go kontinue to speak afta we don leave dis eart for heaven. Oga God go kontinue to talk about our good works kon bless our generason wey dey kom join.
PRAYER:
Oga God, abeg let me be Christian wey dey kanpe wey no dey give up hin faith bekos of di sofa wey he see. Help me to remain focus and faithfully serve you to di end. Abeg bless me and my household, and let all wey follow you faithfully receive di crown of glory for heaven. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen
