Sin Dey Abominable To God’s Sight
David sin against Oga God, and he sofa di konsequence fo am. [God promise through Prophet Nathan say Him go make David pay fo hin adultery wit Bathsheba, and bekos say he kill her husband (2 Samuel 12:7-12). Krises kon happen fo David house. Two of hin children dey sleep wit dea self; one of dem kill anoda pesin. One of David son kill hin own broda kon make love wit hin papa konkubine fo public. Di same child also komot David from di throne, and try to kill am self. David lost hin throne kon run overnight. Mr David lost everything wey he get kon dey unhappy. Some tins wey show di sofa wey David get bekos of hin sin dey down:
1. David children dey sleep wit dea self: “...Tamar ansa, “No! Make you nor force mi do that kind bad tin wey dey bring disgrace! How I go take face pipu fo public again? Dem go disgrace you fo Israel too. So abeg, make you go tell di king, I dey sure sey e go give mi to you as your wife.” Amnon nor gri, but bikos e get power pass di girl, e kon force and sleep with am.” (2 Samuel 13:12-14)
2. David son kill hin own broda “Now, Absalom don tell hin own savants say, "Make una look, wen Amnon don drink well-well, den if I give di order, make una kill-am. Make una nor fear, but get mind, bikos I go take all di blame!” So en savants do wetin Absalom talk kon kill Amnon. David children wey remain kon klimb dea horse bigin run.:” (2 Samuel 13:28-29).
3. David son kommit adultery with hin papa koncubines: “Ahitofel answer, “Go sleep with your papa girl-friends wey e leave fo di palace. Den everybody fo Israel go know sey your papa hate you and dos wey dey follow you, go kon get heart.” So dem set one tent fo di palace roof fo Absalom and fo everybody present, Absalom enter kon sleep with en papa girl-friends.” (2 Samuel 16:21-22).
4. David son pursue hin papa,wan kill am join: “One messenger kon go tell David, “All di pipu fo Israel dey loyal to Absalom.” So David tell all en officer wey dey with am fo Jerusalem, “Make we run at ones, so dat Absalom nor go kill us! Make una hurry or e go come defeat and kill everybody fo di town!” (2 Samuel 15:13-14).
LESSON
Sin dey vex God, he dey evil, and fit make child of God to sofa. Sin go force God make he witdraw hin protection from any pesin weh dey do am, and go give Satan chance to operate. So, children of God must dey kareful so dem no go receive sin bekos di result no good at all. Howeva, hope still dey fo sina wey repent from hin sin. Di merciful and forgiving God go show mercy on any pesin wey jejely konfes hin sin kon repent from dem.
PRAYER
Oga God, abeg guide my footstep so dat i no go sin against you. No let me sin against you, so dat Satan no go get pawa over me. Kon give me pawa through your Holy Spirit to obey your kommandment, and help me to faithfully serve you so dat i go fit prospa fo all di days of my life. Na fo Oga Jesus Krist name i beg all dis. Amen.
