Reject Wrong Teashing and Doctrines
Kristen most to dey watch for teasha wey go dey deceive dem for dia own pocket. Some tisha and teashing wey no konfam wit bible dey out dere, and bilivas most to dey watchful so dem no go bekom dia viktim. Apostle Paul don warn di Galatians church like dat before wen he talk say, “I sopraiz sey una kwik turn back from di Pesin wey koll una with en grace kon bigin follow oda tishing. Nor bi sey anoda gospel really dey, but some pipol dey disturb una, bikos dem won shange wetin wi prish about Christ. But if wi (or angels wey kom from heaven) tish una difren tins from di one wey wi prish give una before, make God distroy us with fire! As I tok before, I dey repeat am again, if anybody dey tish difren tins from di ones wey wi prish give una before, make God trow dat pesin for hell!” (Galatians 1:6-9).
LESSON
Kristen most to dey reject ordinary teashing wey no get basis for di bible. Bilivas wey be heavenly bound no sopos dey bilive anitin wey a tesha bring to am wey no get fact wey dey establish. Notin dey konfam pass di bible, and it remain di manual wey all kristen go dey folow. So, all kristen most to dey check well-well wateva dey teash den wit di bible; teashing wey no get root for di bible mist to dey rejected! On di oda hand, he dey impotant make kristen dey pray kon dey ask for di Holy Spirit make he dey tell dem di meaning ova all mata. Di Spirit of God go put light on all mata, and he go put light on our minds to ondastand di trut. Also, di Holy Spirit of God go give us pawa to dey folow wetin di skripture talk.
PRAYER
Oga God, abeg help me to dey study di bible evritime and to dey listen to di leadership of di Holy Spirit. No let me dey lazy to dey stodi yur word. Also, let me dey prayerfully konsida evri teashing wey dey before me, and dey give me grace to reject teashing wey go deceive me let me be lazy in studying your word. Also, let me prayerfully consider every teaching that is presented to me, and give me grace to reject deceptive teachings. Help me to dey accept and dey celebrate all trut wey go free me from sin, and make dey heavenly bound. Let yur word and leadership of di Holy Spirit prospa me now, and always. Na for Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
