Preaching Di Gospel Wen He dey Okay And He no Dey Okay
Andrew and hin friend hear say John talk am say Oga Jesus na di Krist wey God sent to safe di world, and dey follow krist to bekome him disciples. Andre later invite him broda Simon Peter to meet Oga Jesus. Di bible talk say, “Andru, Simon Pita broda, na one fo di disciples wey hear wetin John talk kon follow Jesus. E first go find en broda Simon kon tell am, “We don see di Mezaya”, (wey mean Krist). Andru kon bring Simon kom meet Jesus. Wen Jesus see am, e tell am, “You be Simon, John pikin, na Cefas (wey mean Pita) pipu go dey call you from today go.” (John 1:40-42). On di oda hand, Oga Jesus find Philip and he make am Hin disciple too. Howeva Philip too kon invite Nathaniel to join him new Oga. Di inviteson kontinue, and more pipu join Oga Jesus to bekome Hin disciples. Di more pipu honor Oga Jesus inviteson, di more dey bekome di shidren of God. Howeva, as di kingdom of God kon dey get plenti pipu through Oga Jesus inviteson, pipu kon dey komot from di kindom of Satan! Di inviteson still kontinue today.
LESSON
Na good tin to dey preach di gospel of Oga Jesus to all pipu. Evrione fit no ansa our call of salvason, and di train of salvason fit no pick evrione at di same time, but di trend go grow fo sure. Di more di invitations we dey send out, di beta opportunity we get to catch more pipu fo di kingdom of God. Now, bilivas must risk to preach Krist’s gospel to all pipu – without exceptions. Howeva, we must not dey diskoraged if we no see quick turnout. Di result of our aktions fit no show fo eart but go show fo heaven. On di oda hand, some pipu fit listen to di gospel now kon shange later. No kristen must wait fo di time wey dey okay fo dem to preach di gospel, and nobodi must wait make pesin.
