Oga Jesus Krist No Be Man
Oga Jesus Krist teach di Pharisees some bitter truth wey vex dem. He talk say, “that provoked dem to rage. He say“ Una papa Abraham happy well-well wen e hear sey I dey kom. E si am and e happy well-well.” Den di pipol ask am, “Yu neva old rish fifty years and yu sey yu don si Abraham?” Jesus ansa dem, “Na true word I dey tell una so, before dem born Abraham, I don already dey!” Den, dem kon pick stone won stone am, but Jesus hide kon komot from di temple aria. (John 8:56-59).
Lesson
Na for eart dey born Oga Jesus Krist and na like human being dey born am, but he pads ordinary human being. He be God in human form. True-True wen Oga Jesus dey for eart,he walk like man,talk like man, but he no be ordinary man – He be God wey show for flesh! Di skripture tok am say Oga Jesus na God for human flesh wen he tok say, “Since wen di time start naim di Word dey and di Word dey with God and na God ensef bi di Word. Di Word dey with God from wen time bigin. Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all. Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get. Di lite dey shine inside darkness, but darkness nor gri with am.” (John 1:1-5).
Prayer
Oga Jesus be God in human flesh, and he be Lord. I dey sure say Oga Jesus na di savior of di world. So, I give my komplete life to him. I dey repeat am say my komplete life don dey wit Oga Jesus Krist! I komand Satan to komot from my life since I don be shaid of God. For I make dis konfam deklarasans thru di authority wey dey di name of Oga Jesus Krist. Amen.
