Oga Jesus Get Di Pawa Of Life
Lazarus die from serious ailments and dey bury am, but Oga Jesus Krist kon come on di fourth day to wake am bak. Oga Jesus wey dem don tell before say Lazarus no well no gree come quick ontil Satan do wetin he wan do. Di savior don dey prepared to disgrace Satan kon glorify Hinsef. In fact, Oga Jesus tell wetin he wan do to Lazarus sister (Mary) wen he tok say, “Na mi bi di resureshon and na mi dey give life. Anybody wey bilive mi go get life even if e don die and di pesin wey bilive mi fo dis life, nor go ever die. Marta, you bilive wetin I tok so?” (John 11:25-26). As Lazarus die, Oga Jesus come to di town to wake am up. Hallelujah!
LESSON
Satan don dey trouble bekos Oga Jesus Krist get pawa over death. Di worse tin wey di enemi fit do na to kill pesin, but Oga Jesus go wake up belivas wey don die kon send dem to heaven. But fo Satan and hin folowas, dea permanent home na fo hell fire. Dem go roll fo fire wey no dey die, dem go dey torture dem evri day and night – foreva! Howeva, pipu wey belive in Oga Jesus Krist go enjoy God peace and prosperity fo heaven – foreva!
PRAYER
Praise Oga Jesus Jesus I don be born again, I dey go heaven. I no go go to hell fire bekos say I be folowas of Oga Jesus Krist. Heaven na my home, and I go enjoy am foreva! Since Oga Jesus don win Satan through Hin death and Hin resurrection some two thousand years ago, I deklare my victory in Am. Devil no get pawa ova me again; I don dey free from any curse of sin and death – foreva! Yes, I dey free! Yes, Oga Jesus Krist don make me feee. Amen.
