Oga Jesus Don Established Di Purpose Of Di Gospel
Nicodemus wey be impotant Pharisees kom mit Oga Jesus Krist fo secret to learn about di gospel wey most of di Pharisee no won hear. Even say hin no dey usual make di Pharisee dey kom meet Oga Jesus Krist, Oga Jesus use dat time explain to Nikodemus about di gospel. Di enkounta fit be different tin fo Nikodemus, but na opportunity fo Oga Jesus to safe a soul wey don lost. Di Messiah use plenti time with Nikodemus to dey explain to am di reason him (and oda pipu) must enta di kindom of God. Di skripture talk am Nikodemus enkounta wit Oga Jesus, “E get one man wey bi Farisee, en name na Nikodimos and e bi memba fo di kansol wey dey rule Jew pipu. E hide go meet Jesus fo night kon tell am, “Tisha, wi know sey you bi di pesin wey God send come meet us, bikos nobody fit do di mirakles wey you dey do, unless God dey with am.” Jesus speak with Nicodemus (John 3:1-21) Jesus tell am, “Make I tell you true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit see God kingdom.” Den Nikodimos ask am, “How dem go fit take born pesin wey don old fo di sekond time? Abi di pesin go enter en mama belle make di mama born am again? E fit happen like dat?” Jesus answer am, “I tell you di truth, unless God born pesin with wota and en Spirit, di pesin nor go fit enter God kingdom. Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi. So, make you nor konfuse bikos I talk say, ‘God go born you fo di sekond time.’ Wen breeze dey blow, e dey go anywhere e wont, you dey hear di sound wey e dey make, but you nor fit know where e dey come from or where e dey go. Na so e bi with evribody wey God Spirit born.” (John 3:1-8).
LESSON
Oga Jesus Krist use every chance wey he get to preach di gospel to di sinas wen he still dey on eart. Even say hin opponents no bilieve am, Oga Jesus still dey show good attitude to all pipu. He no reject anibodi, but he accept any pesin wey dey show interest fo hin message. Out of hin generous heart to di pharisee, Oga Jesus answer all question wey Nikodemus ask am. Di anda don bekome di highest point of faith fo all kristen. Dem don bekome wetin dem dey use preach, phrase, and klause fo biliever to dey use talk to di lost sinner and lead dem to God salvation. Oga Jesus tell Nikodemus say:
1. “Make I tell you true word, unless dem born pesin di sekond time, e nor go fit si God kingdom.” (John 3:3).
2.“as Moses karry di snake go up wen dem dey inside desert, na so too dem go karry Man Pikin up so dat anybody wey believe am, go get life wey nor dey end.” (John 3:14-15).
3. “God love di pipu wey dey dis world well-well, so E kon send di only pikin wey E get to us, so dat anybody wey believe am, nor go die, but e go get life wey nor dey end.” (John 3:16).
4. “God nor send en pikin kom kondemn di pipu wey dey inside di world, but make e kom safe dem.” (John 3:17).
5. “Anybody wey belive am, God nor go kondemn am. But di pesin wey nor belive am, God don kondemn am already, bikos di pesin nor belive God Pikin name.” (John 3:18).
PRAYER
Oga Jesus Krist, what a wonderful Lord you be! You don talk your gospel fo all pipu to benefit. You endure persekusons, kon show heart wey dey love to pipu wey no dey friendly. You sofa plenti abuse because you wan safe di world! I love you Oga Jesus Krist, and I promise to exchange your love with my life. From now, I konfes you as di Son of Oga God, and I accept you inside my life as my personal Lord and Savior. I konfes my sins kon repent from dem; I go serve you fo all di days of my life. I dey use this time to ask fo your grace to preach di gospel kon engage odas ontil dey sorenda dea lives fo you. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
