Oga God Want Repentans
Because we show repentance no be sign say we no get courage; na sign honesty to di living God. Pipu wey dey true and humble no go dey ashamed to repent from dea sins. Dey refuse to dey enjoy fo sin, but repent from dem. Pipu wey repent also get hope in God to have strength wey dem need to overcome temptations wey go come later. A prophet confess hin stand wit God kon declare hin hope fo victorious future. Di prophet talk say, “So my enemies, make una nor happy, because of me! Because wen ever I fall, I go raiz-up again. Even doh I dey fo darkness, Oga God go be my light. I go dey patient as God dey punish me, because I don sin against am. But after E don punish me, E go fight fo me kon make me win. God go take me enter di light and i go see en rightiousness.” (Micah 7:8-9).
LESSON
God love pipu wey dey humble to repent from dea sins. He dey appreciate dem say dem get di courage to komot fo evil kon dey pursue righteousness. Di bible talk say, “God dey against pesin wey dey karry body up, but E dey give grace to pipu wey dey put dea body down.” (James 4:6). So, children of God must to put dea attention on repentance of sin. Any child of God wey fall fo sin should repent, so that he/she go get God forgiveness. Di creator be papa wey dey love, and he go forgive con bring back sina wey repent.
PRAYER
Oga God, I be sina, and I dey sorry fo my sins. I understand say you be pesin wey dey love and dey forgive; Now, I talk say make you forgive me all my sins. Kon bring am back to me di joy of my salvation. Let your Holy Spirit give me pawa to dey overcome di enemi temptation. Abeg help me to dey strong fo righteousness, and let me to dey listen to your laws. Abeg keep me kanpe to dey receive your blessin on eart, and fo heaven also. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
