No Sepreson With God
Paul Shange pesin wey dey attack di church to pesin wey dey preach fo church. Oga God safe am while he dey tracel to attack di kristen. Paul share wetin hin eyes see, “I sofa Christians and I dey kill pipu wey dey serve God, dey tie pipu trow fo prison, weda dem bi man or woman and even di High Priest and di kansol eldas know about mi. From dem, I kollect leta go give dea brodas wey dey fo Damaskus, so dat I go arrest pipu wey bilive krist kon bring dem kom Jerusalem put fo prison. As I dey go, near Damaskus, around aftanoon, one kind light from heaven kon shine round mi. Den I fall fo groun kon hear one vois wey sey, ‘Saul, Saul, why you dey ponish mi?’ I ansa, ‘Who you bi Oga God?’ E kon sey, ‘I bi Jesus Krist wey kom from Nazaret, wey you dey ponish.”(Acts 22:4-8).
LESSON
God dey interested to safe any sina from hin sin. He want make sina repent from hin sin kon accept di salvason offa of hin Son Oga Jesus Krist. Di salvason dey precious but dey free to evribodi. Anybodi wey kom mit Oga Jesus Krist go dey safe from hin dirty no mata how bad he dey. Oga Jesus go repair any life wey don spoil kon make am beautiful fo di kindom of God. Any pesin fit kom to Oga Jesus Krist to receive hin salvason. Pesin wey dey do any religion go dey safe wen he kom mit Oga Jesus Krist – whether na Muslim, Buddhist, Hindu, traditionalist, or odas. All pipu must to ondastand say no oda way dey to get life wey no dey finish oda dan thru konfeson of faith in Oga Jesus Krist. Anybodi wey konfes Oga Jesus Krist as hin Lord go dey safe. Oga Jesus tok say, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.” (John 14:6).
PRAYER
Oga God, I ondastand say konfeson of faith in Oga Jesus Krist na di only way to get salvason. Anybodi wey konfes Oga Jesus Krist as Lord go dey safe! Now, I dey make my deklarasons today say I bilive in Oga Jesus Krist. He be di Son of Oga God. He died fo my sins so I go dey safe. I konfes Him (Oga Jesus Krist) as my personal Lord and Savior. I go serve you from today and all di days of my life. Abeg give me strength to serve you to di end. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
