New Eart
Oga God design di present eart to dey exist fo di main time. He no go exist again as di bible talk am, “I go swip everything komot from dis eart. I go swip both pipu and animals.
I go destroy di birds fo di sky and di fish fo sea. I go turn wicked pipu place to wea dem dey trowey dirty put kon destroy human being komot from dis eart.” (Zephaniah 1:2-3).However, Jehovah promised say he go replace our corrupt eart with a beta one wey go be perfect house fo Hin saints. Only God saints go qualify to enjoy di new eart! Oga God talk say, “Make una know sey, fo that time, I go make di nations praise Me well-well. All of dem go dey pray with my name kon worship Me with one spirit. My pipu wey skata before, go from di oda side fo Ethiopia river kon sacrifice give Me. Fo that day, una nor go dey shame bikos of all una sturbones against Me. I go destroy dose wey dey boast among una And una nor go ever dey sturbbon fo My holy hill again. Pipu wey dey honbol and good, Na dem go stay with una and dem go dey safe fo God present. Israel pipu wey remain, nor go dey sin again. Dem nor go lie and to deceive pipu, nor go dey dea mind again. True-true, dem go dey chop and sleep well And nor-tin go make dem fear again.” (Zephaniah 3:9-13).
LESSON
Di present eart no go last fo life, but go kom to end at di time wey God talk. Jehovah go establish new eart wey dey free of wickedness and corrupson. Only dose wey don serve God faithfully kon believe in di testimoyi of di Lord Jesus Krist go qualify to enta di new eart and new heaven weh God go establish. All woka of injustice no go qualify to partake in di paradise ( new eart). Wicked pipu no go fit enta, but dem go get dea portion fo di lake of fire. (Revelation 21:1-3).
PRAYER
Oga God, abeg make me qualify fo your kingdom. Keep my feet stand gidigba fo your gare by living a lifestyle wey meet your standard. Make your Holy Spirit guide dey guide me into all righteousness, so that my name go dey written fo di book of life. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
