Na God help good pass
Oga Jesus krist tel hin pikin wey dey folow am how dem go dey pray fo Luke 11:2-4; he tell dem make dem dey put faith for dea preya so dem go see wetin dem want. Oa Jesus talk am say pipu wey bad no wetin good fo dea shidren, wetin won kon stop him make hin no help hin pikin wey trust am wit dea preya. Oga Jesus talk say"since una fit give una pikin good tins as una bad rish, wot of una Papa fo Heaven wey go give di Holy Spirit to anybody wey ask am?”(Luke 11:13).
LESSON
God fit help us pass human, di kreato no bi man, he no fit do as man dey do lailai!. Jehovah get plenti tins wey dey him domot and hin redi to help pipu who trust am. Belivas must kip dea faith in God fo he go jejely handu wetin dey hapun to dem and make dem dey enjoy. God go ansa di preya of hin pipu so hin go honor hin name fo dea lives.
PRAYER
God abeg, i dey ask say make you kon help me so i go trust you anitime i nid you, kon help me dey look fo your face wen i dey pray, kon help me to dey use my faith, kon help me make my konfidens dey gidigba wit songs we get testimoni inside, abeg kip my faith kanpe till i don see wetin i want. Na fo oga Jesus krist name i beg all dis. AMEN
