Lessons For Hard Times
Poblem force make David know hin true friends. He don think before say all di pipu love am, until hin own pikin komot am from King and hin own pipu join hin pikin. While David run fo hin own son Absalom, one man weh dem dey call Shimei get kourage to show hin true color. He korse David to hin face, kon pour sand, throw stone to him to show say he no like hin government. Di skripture talk am say, “Wen David reach Bahurim, one Saul relation wey dem dey coll Shimei wey bi Gera pikin come out bigin start to dey about David. Shimei start to stone David, en officer and en bodyguards. Shimei curse am dey sey, “Make you get out! I sey make you dey go! You wey kill pipu! Wicked man! You take Saul kingdom and naw, God dey punish you fo all di pipu wey you kill fo Saul family. God don give di kingdom to Absalom your pikin. You don fall; you wey dey kill pipu anyhow!” (2 Samuel 16:5-8). But Shimei later beg, but en don learn hin lesson! (2 Samuel 19:18-20).
LESSON
Life dey all about learning, and shidren of God must dey learn from every situation wey dem experience. Oga God no dey sofa anybody, but he go allow hin pikin pass through difficult situations, so dat dem go learn some necessary lessons wey dem go won avoid. Oga God teach lessons fo sofa, and he dey use situation wey no dey okay to make us dey gidigba. So, we christian must dey learn from every situation wey come our way. We must learn how to explain di voice of God through sofa, and we must learn how to dey listen and do as he want! Depend on di situations, we fit no need to find a quick solution until we don learn enough lesson. Make we no doubt am, God go turn our sofa to enjoymenti after we don learn our lesson. Di kreator go surely help us overcome every problem wey we dey face, and he go use every sofa wey we see to build our character and konfidens; he go turn us to sharp instrument wey dey fit fo hin glory.
PRAYER
Oga God, abeg teach me every lesson wey i need to learn. Help me to dey respond to training well-well, kon use every chalenge wey I face to build my kareer and konfidens so I go dey fit fo your honor. Turn whatever situation di enemy don plan fo evil to goodness. Kon train and fine-tune your grace fo my life so I go dey prosper fo dis life, and fo your kindom also. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
