Kontinue to Exercise Your faith In God
Caleb get hin reward fo di konfidens wey he show in God wen odas don fail. Na only Caleb and Joshua talk dea faith in God wen twelve dem pipu say make dem go spy Cannan Land.
Odas use diasef kompare grasshopper against dem giants,and no belive say God's power fit deliva dem. Therefore, God son promise say he go honor Caleb (Numbers 14:24). Moreova,no bi say Caleb only show hin faith fo di border of Canaan Land,but he also kontinue to show hin strong faith even wen he don dey old. Wen he bi 85 years, Caleb work to Joshua to ask for hin own portion of inheritance. He go meet Joshua and talk say, I bi forty years wen Moses, God savant send mi from Kadesh Barnea go spy di land and I kom back kon tell am di trut. Doz wey follow mi kon dey make Israel pipu fear, but i still dey loyal to di Oga my God. Dat day, Moses kon promise mi, ‘Any land wey you waka enter, go bi you and your family own forever, bikos you dey loyal to di Oga your God.’
“So naw, make you si, God don keep mi rish naw, just as E promise. Fo dis forty-five years, even since God tell Moses en word wen Israel pipul still dey di wildaness kom rish naw, I nor die and naw, I bi eighty-five years. Yet, I still strong like wen Moses send mi go spy. I fit still fight kon do my evriday work with di same power wey i get dat time. So make you give mi di kountry fo hill wey God promise mi dat time! Dat time, you know sey na Anak pipu dey dea wit dea big-big towns. But if God dey wit mi, I go distroy dem, as God promise.”Den Joshua bless Kaleb, Jefunneh pikin kon give Hebron land to am. So till today, Kaleb wey en papa na Jefunneh from Kenizz kon take Hebron land, bikos e dey loyal to God. Before-before, dem dey koll Hebron, Kiriat-Arba. Na Arba bi Anak pipu papa and evribody know am. So afta dis time, war nor kon dey di land again.” (Joshua 14:7-15).
LESSON
Eni one wey show faith fo God no go dey put to shame- no mata di kondition! God wey dey encourage pipu make dem trust am no go leave whoeva do di same tin. Indeed, di world may bi like say everitin don scata fo pesin wey get faith,but since hin trust still dey in God, di storm go stop so di pesin go kon dey enjoy.
Howeva, bus-stop no dey fo di nid to apply faith fo evri one life. (we fit apply faith fo any situation of life so we go fit dey enjoy as a beliva). In oda words,we fit apply our faith fo bill payment, healing, job, marriage, shidren, business deal, and others. Therefore, pipu wey dey call di name of God must to dey put dea faith in him so dem go fit get victory evritym fo dea lives. Di face of pipu wey get faith go dey shine wen rain dey fall and wen sum dey shine to honor God's name!
PRAYER
God abeg, abeg help me to dey apply my faith wey dey gidigba to evri situation so i go get victory and to dey glorify your name. Kon help me show my faith wey dey gidigba even wen challenges come,let my faith dey strong as rock to stop all oppositions and konfes your strength wey dey safe pesin! let me dey able to say wen tins no dey fine say, "My God wey i dey serve dey able and he go komot me from di problem wey i dey!".Abeg make me come back into di assembly of your pipu so i go fit talk about your goodness, so oda pipu go dey show dea faith in you. Na fo oga Jesus krist name desire to have faith wey dey konfam in you. Amen
