It Is Important To Have A Repentant Heart
Jeremiah lament fo Israelites wen he don witness di konsequence of dea rebellion behaviour against God. Jeremiah cry,
“How lonely sits di city wey dey wit plenty people! How like widow she be, weh dey great among di nation! Di princess among di provinces don become slave! She weep bitterly fo night, her tears dey her cheeks; among all her lovers she no get comfort. All her friends don deal treacherously with her; dem don become her enemies.Judah don dey in captive, under affliction and hard servitude; She dwell among di nation, she no find rest; all her persecutors overtake her in dire straits” (Lamentation 1:1-3).
LESSON:
God award few konsequence fo human actions. Everyone - without exemption - na danger fo paying terrible konsequence fo hin or her action weh he commit against Am. God penalty fo sin fit beat our imaginations, since we no fit underestimate Hin action. However, Di kreator go be willing to work with any sinner, and see him/her repent to avoid penalty. Jehovah give window of opportunity fo repentance, and expect a sinner to take necessary repentant action. However, di kreator no go leave Hin door of grace open indefinitely, He gol award punishment fo sin and make unrepentant sinners pay dire consequences fo dea actions. Hence, e dey profitable fo every disobedient child to turn to new leaf and return to God with repent heart. God go honor those weh submit and serve Am with humility. He go respect sinners weh repent; forgive dea sins, and restore dem into Hin divine purpose fo dea lives.
PRAYER:
Dear God, I beg give me humble heart to change from my sins and make necessary amendment, so that I fit remain your true child. I no won be di stubborn child weh refuse to repent and dey punish. I want to follow you wholeheartedly! Help me make i no dey rationalize sin,but make i dey honest inside wetin i dey do fo your presence so i go dey bless. I beg prosper and perfect everitin weh concern me. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
