Honour God And Hin Ministas
Oga God no dey hapi with woman wey take King David laugh after he dance and praise Am. David call a party fo God and he call everybody make dem come watch am as he dance before the Ark of God; However, David wife (Michal) no de happy with am kon dey laugh am. She talk say the King no give hinsef honor to perform fo that event. Michal later face David kon say, “…Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef fo en girls servant and officers! (2 Samuel 6:20).” However, Oga God and David vex fo wetin Michal do; so, Michal no born child.Di bible talk am say, “David answer, “I dey dance to honor God wey choose mi, instead of your papa and en family. E make mi lead Israel wey bi en pipu. I go continue to dey respect God with my dance and I go disgrace mysef pass like this. You fit think sey I fool mysef fo pipu front, but dose girls go respect mi more-more!” Because of dis tin, Mikal wey be Saul pikin, nor born any pikin till she die.” (2 Samuel 6:21-23).
LESSON
No pesin must to laugh God and Hin servants. God dey too big pass make pesin dey laugh Am, and Hin servants na pipu wey get respect fo body! Make we no dey surprise to see God say He vex fo pesin wey dey do anyhow to him and Hin servants. So, every pesin need to dey careful so dem no go make God vex! On di oda hand, Jehovah dey keep blessing fo pipu wey honor am and dey give respect to Hin servants. Any pesin wey see God as pesin wey big kon dey respect Hin servants go get Hin blessing.
PRAYER
Oga God, I like am to dey receive small blessing don dey receive plenty curse. Now, I don talk am say i dey honor you kon respect your servants so I go fit prosper. Abeg no let me take you or your servants fo granted, but help me dey give am to you wetin you suppose get so I go fit prosper fo di land of di living. Na fo Oga Jesus Krist name I beg all dis. Amen.
