Have Faith In God
Faith dey important to humans and God. Na di connecting rod between di two. Person without faith no fit relate with God, even if he attempt am, God no go respond. Di bible talk am,
“Now faith na di substance of things we dey hope fo, di evidence of things weh we no see. For wit am di elders obtained good testimony. By faith we understand say world was frame by di word of God, so that di things weh we dey see nobi sey dem make dem wit things weh dey visible” (Hebrews 11:1-3).
LESSON:
Faith na di anchor of creation. God create all things by faith. The kreator get trust in Himself by creating everitin thing out of nothing. With word of kommand He create di earth, and everything inside am. God say, “Let dea be...” (Genesis 1). Anything He talk come to existence. Meanwhile, since God trust Himself, Hin kreation must also trust Am to live a proper function life. Kreation must get faith in God weh create am. Human must believe in God existence; dey must trust Hin pawa, and dey must profess dea expectations in Am - as though dem go irrevocably manifest. Person weh dey expects di manifestation of God supernatural pawa must believe sey God fit do all things, and di fellow must declare him/her committed faith inside Am.
PRAYER:
Dear God, i beg help me to get faith in you; give me strength to be able to declare my confidence inside you over every area inside my life. Make your Holy Spirit give me pawa to be able to declare bible promise and claim dem into my life. Let my confessions dey positive, and make me live triumphant life on dis earth. I beg make me to reap fruits of faith, and make my testimony abide. Fo in Oga Jesus Krist name i make my requests. Amen.
